Poetry: Ẹ gbé Kinní Yìí Wá Joor

By Bolutife Oluwadele

Chief Èmi ló kàn of Lasgidi
Dokinta Eléyìí of the abroad
Which kin nansense greetings be dis nau
Dat wan wey you greet me nko?
Na you go yarn say you nor laik am nau
Dat is wai I send am back to sender.

Weldon, Sir Agbà lọ́wọ́ mé ríi of the Universe
Abi na you be ritaya Zacchaeus
Beht Zacchaeus change im way for beta somtin
Taim still dey to change too

You tink so true true
You mean say e go too hard for Leopard
To change im color to somtin
It is efin impossicat sef

Wahala go dey for bunker be dat
You nor go kari apoti for election?
Nor be only apoti I go come kari
Come kari Ghana Must Go join am o

E be laik you don chop delegates somtin o
For wia, dem nor gree sakuleti dem kusa
You mean say e nor rish ground at all at all
Aswear, Shingba I nor take my korokoro eye see

Who you come dey follow for back
Hao dat wan take consine ya
We nor be paddy again.
Paddy paddy don ritaya for jungle o.

Abi you dey wait for ya èmi ló kàn package
You know wia dem dey take kolet
Na you I for ask nau
Nor be efiritin you dey shook mouth.

You don dey buga me fah!
Hao I nor go buga.
Na so we go dey roll
Wetin I gain if I nor buga ya

Dem say Obi don dey go Egypt
Im say e wan go climb NEPA pole dia nau
NEPA pole bi baawo?
To follow draw waya come Naija nau

Na so dem dey do am?
Im say e wan make efiriwia get kwaret light
And make business nor dey dance Atilogu again
Beht make dem dey kari moni go Bank wella

Dat wan make sense nau
You for yarn say e make sense die sef
You nor too laik am laikdat
Feofle wey go tif the waya full ground o

Haba, make you dey tink beta somtin nau
Abegi make Sowore bring gbana for efiriwan joor
Hao dat wan come take beta
Na you sabi wetin you dey yarn o.

You neva ansa my kwesion o
Which yeye kwesion you ask sef
Who you dey support for 2023
Lemme o, I take Baba God beg ya.

Abi na sitomaki infrastructure you dey
Wahala dey hinsaid dat wan again
I just dey ask ni o
Kontinuu you hia.

You know henniwan wey do delegate
Say wetin hapin nau
I wan check somtin nau
Longer throat don dey do you abi?
Persin nor fit just know somtin ni
Na alat you don dey kakuleti for ya head

Hao you tink laik dis nau
Nor be today I sabi wetin you fit do
I nor dey follow do kwaropshan o
I trust ya for dat wan
Wetin you come dey yarn den
Make we yarn anoda somtin

True true you nor kolet hennitin
Somtin don dey do ya
Ma fren, nothing do me
You see hennitin for my hand

Dem dey show am openly
Nor be efiriwan wey oyel dey im mouth lick soup o
Beht hao we go take know say you nor lick
Go do forensic abi wetin you dey call am sef
Make we do lips forensic?
Hennitin wey you laik do
If we come kash you nko
Na im be say èmi ló kàn be dat.

©TheVillageBoy

Post a Comment

Previous Post Next Post